Home As e de hot Help to make Healthcare Chim for Naija – Dogara, Dr. Laz, others...

Help to make Healthcare Chim for Naija – Dogara, Dr. Laz, others yan Lawmakers-elect

703
0

As young lawmakers-elect gather for Abuja to jinja and prepare on how dem go represent well, different guest speakers and panelists don charge dem to help make healthcare dey kajad for obodo Naija. Na for the program wey YIAGA Africa and the NotTooYoungToRun Movement organise wey different sabinus for government and body-mata follow do the talk.

Na Speaker Yakubu Dogara, Ms Serah Makka-Ugbabe of ONE Campaign, Dr. Laz Eze of Pink Oak Cancer Trust and veteran NTA newscaster, Mrs Eugenia Abu give this talk on Tuesday 7th May 2019 for inside Transcorp Hilton, Abuja. Dem talk say the level of health sector no pure at all as Naija people just dey die anyhow like chicken. Dem tell lawmakers wey just win election make dem use their power make sure say government for federal and state levels dey budget plenty money for health, release am on time and use am well to improve quality.

Dr. Eze sef emphasise say na strong Primary Healthcare go help make health system strong. Lawmakers wey follow our tori people talk bin show happiness about things wey dem learn.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.