As obodo world dey mark World Health Day today, The Pink Oak Cancer Trust don beg Presido Muhammadu Buhari and the Governors of the 36 States make dem join hand establish a compulsory health insurance wey go cover cancer diagnosis and treatment. The Executive Director, Dr. Laz Ude Eze talk say quality healthcare suppose dey available, affordable and accessible to every Nigerian to guarantee right to life as e dey for our law book of 1999 Constitution (as amended).
According by Dr. Eze, Naija get the highest number of people wey dey die from cancer for obodo world because patients no fit afford care and better equipment no reach. He talk say Pink Oak and their partners dey raise N350 million this year to sponsor the treatment of 100 cancer patients in early stages of cancer.
Good one Boss