Home As e de hot West African Body-mata Sabinus Move SDG Torchightment to Higher Level

West African Body-mata Sabinus Move SDG Torchightment to Higher Level

People wey attend bin look into the torchlightment of how SDG measurement indicators take be for Ghana, Burkina Faso and Senegal. After plenty grammar and exchange of ideas, dem come gree say dem go join hand together like broom and work together like ants to make sure say dem move body-mata SDGs implement to a higher level for West Africa.

882
0
All the body-mata sabinus for West Africa wey dey the workshop

Plenty sabinus people for body-mata wey oyinbo dey call health experts from different West African countries don gather for Dakar Senegal to reason together on how dem go take torchlightment of obodo-world development plan wey concern body-mata (health-related Sustainable Development Goals, SDG) to a better level.

People wey attend bin look into the torchlightment of how SDG measurement indicators take be for Ghana, Burkina Faso and Senegal. After plenty grammar and exchange of ideas, dem come gree say dem go join hand together like broom and work together like ants to make sure say dem move body-mata SDGs implement to a higher level for West Africa.

Our Oga Dr. Laz Ude Eze (Donlaz) follow for the sabinus wey rep Naija for the workshop. Others na Mr. Mukhtar Ijaiya, Dr. Ejemai Eboreime, Mr. Lawrence Nwaka, Ms Ugonna Ukaigwe and Ms Chinenye Ogunro.

Na the join-bodi of body-mata for inside West Africa (a.k.a West African Health Organisation, WAHO), Initative Prospective Agricole et Rurale (IPAR) and the West African Network of Emerging Leaders in Health Policy and Systems (WANEL) join hand organize the program.

See we Naija people: Ugonna, Donlaz, Mukhtar, Lawrence, Chinenye & Ejemai

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.