Home Talkhealth9ja Radio Show Report Body-mata Workers wey Treat You Anyhow – ‘Nonso Umeh

Report Body-mata Workers wey Treat You Anyhow – ‘Nonso Umeh

1011
0
Mr. Chukwunonso Umeh

Sabinus for public body-mata, Mr. Chukwunonso Umeh don call on workers wey dey inside hospitals to make sure say dem dey give better quality service to patients and make sure saving of life na their No. 1 agenda. Mr. Umeh sama dis advice when he appear as guest for the 240th #TalkHealth9ja show for 99.5 Wazobia FM Abuja on 5th April, 2019.

He talk say the ogbonge body-mata law (National Health Act) of 2014 don talk say make every body-mata worker dey use immediate alakrity and without any excuse treat anybody wey dem bring as emergency. He come advise country people make dem report any dokita, nurse, medical lab scientist, pharmacist, etc wey dey behave anyhow to their oga for hospital, Servicom, dem profession council or even law court sef.

Mr. Umeh also beg country people to dey show respect to body-mata people and make everybody play their part to make health sector kakaraka.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.