Home As e de hot Senate Throway Body-mata Insurance Law (NHIS Act 2003), Replace am with a...

Senate Throway Body-mata Insurance Law (NHIS Act 2003), Replace am with a New One

The name of the new law wey Senate President rule "the Ayes have it" before he knack gavel for table na National Health Insurance Act, 2003 (Repeal and Re-enactment) Bill 2019, SB 278.

1294
0

The ogbonge lawmaking body for obodo Naija (Senate) throway the law wey establish the government body wey dey regulate body-mata insurance for Naija (a.k.a National Health Insurance Scheme, NHIS), come carry a new one replace am sharperly. Na today this one happen o.

The name of the new law wey Senate President rule “the Ayes have it” before he knack gavel for table na National Health Insurance Act, 2003 (Repeal and Re-enactment) Bill 2019, SB 278. Na Senator Lanre Tejuosho from Ogun State and Senator Philip Gyunka from Nasarawa State carry the matter put for table before the senators give carry go.

You go remember say plenty Naija people wey call for our TalkHealth9ja radio show bin dey squeeze face talk say the way NHIS dey take work no pure at all at all. Even WHO use this matter of insurance do body-mata report for this 2019. E come look like lawmaker people hear the wetin people talk, with this action wey dem take.

We go bring you more tori on top this new law.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.