Home As e de hot Na Lie Ngige Talk! Naija needs 290,000 more Doctors – NMA

Na Lie Ngige Talk! Naija needs 290,000 more Doctors – NMA

670
0

The National Presido of the join-bodi of doctors for obodo Naija (Nigerian Medical Association – NMA), Dr. Francis Faduyile don talk say the claim by Jobs and Production Minister – Dr Chris Ngige that Naija get surplus doctors no be true at all at all. In short, e say that talk dey “unfortunate”. He say na only 40,000 doctors dey treat 200 million Naija people.

By this number, e mean say one doctor dey for 5000 people instead of 600 wey World Health Organisation (WHO) want. To meet the 1 doctor for 600 people, e mean say Naija needs 330,000 doctors to dey work inside we country. Since we get 40,000 now according by NMA Presido, e remain 290,000 doctors to enter the level wey WHO want.

Abeg make we ask, why be say Chris Ngige – the Job and Production Minister wey be medical doctor, former governor and former senator no sabi this?

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.