Home Things wey happen Minister Adewole Squeezes face on top Low TB Case Finding for Naija

Minister Adewole Squeezes face on top Low TB Case Finding for Naija

744
0
Prof. Isaac Adewole - Body Matter Minister

As obodo world gather to mark the World Tuberculosis (TB) Day for March 24, Oga Minister for body matter, Prof. Isaac Adewole don squeeze face on top the low rate wey Naija take dey find cases of TB. He showed this squeezing of face when he follow tori people talk for Abuja.

According by the minister, “the major thing wey dey draw back the hand of clock for Naija TB program is low TB case finding for both adult and pikins as plenty TB cases dey miss either from say dem no see am or dem see am but no report am.” He talk say ogbonge government don set up committee to gather plenty money from inside obodo Naija to use solve the plenty wahala wey dey face TB program.

Other sabi persons wey include the Oga patapata for ARFH, Prof. Oladapo Ladipo beg government make dem show more seriousness and release more money for the fight against TB for obodo Naija.

For more tori, click on Vanguard or Premium Times reports

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.