Sabinus on top body-mata, Dr. Chinelo Ekweremadu don talk say na good thing make every Naija pesin – young or old, rich or poor, short or tall, man or woman, girl or boy – to get body-mata insurance. She say e go help everybody fit afford treatment for inside better hospital for we country. She talk dis better talk as guest on the 241st TalkHealth9ja show on Friday 12th April, 2019 for 99.5 Wazobia FM Abuja.
Dr. Ekweremadu come beg ogbonge government plus including state government dem make dem show more seriousness for body-mata insurance because na wetin join-bodi of body-mata people for obodo world (a.k.a World Health Organization) dey encourage especially for this year World Health Day. She come beg the National Health Insurance Scheme make dem move to the next level and show Naija people how dem go take join the scheme. According by her, e go help to stop anyhow die wey country people dey die like chicken.
Na MC Bluetooth of Wazobia FM Abuja and our oga Donlaz follow host the show.
