The Oga Madam for the International Society of Media in Public Health (ISMPH), Chief Moji Makanjuola, MFR don call on all Naija people and government to join bodi make sure say pikins dey chop better chop. Chief Makanjuola wey be ogbonge broadcaster wey work before before for
Nigerian Television Authority (NTA) talk this thing for our 238th TalkHealth9ja radio show (on 15th March 2019) inside 99.5 Wazobia FM Abuja.
According by her, “we no dey fight war, why plenty of our pikin go still dey suffer malnutrition?” She advised local, state and ogbonge government to put plenty money for nutrition matter and use am well to make pikins body kajadly kajad.
Oga Donlaz and Willy Willy wey host the show put mouth sef beg mama dem make dem breastfeed their pikin with only their breast milk for first 6 months of life.
