According by Pikin Rights Law (Child Rights Act for oyinbo), immunization na compulsory thing and na right of every pikin for obodo Naija. Na so Barrister Kenechuckwu Agwu, Project Officer for Network of University Legal Aid Institution talk on top our 239th TalkHealth9ja show (22/03/2019) inside Wazobia FM Abuja.
Barr. Agwu come advise papa and mama dem to carry their pikin go health centers and hospitals to get proper immunization because if dem no do am, na breaking of the rights of the pikin and law of government be dat. He come beg states wey never pass the Pikin Rights Law to do am sharperly.