The oga for Pink Oak Cancer Trust wey be join body of NGOs wey dey raise money to give people wey get cancer make dem carry treat themselves, Dr Laz Ude Eze (a.k.a Donlaz) don blow plenty grammar dey tell next presido wey Naija people go elect to take cancer matter very serious.
According by Oga Donlaz, wey be our oga sef, he talk say the sufferness wey cancer patients dey suffer for obodo Naija too much as plenty of them no get money to treat themselves. Even those wey get money sometimes no dey get ogbonge treatment.
He come tell Naija people to shine dem eyes vote for person wey go show say body matter dey importankpa and wey go put plenty money to take make am kpoikally kpoi kpoi.
To torchlight the details, make you click here. Make we warn o… grammar brekete for inside o.