Home As e de hot #WorldCancerDay: Pink Oak don hammer as dem get 500k donation to fight...

#WorldCancerDay: Pink Oak don hammer as dem get 500k donation to fight cancer

536
0
Oga for Pink Oak, Dr. Laz Eze and Pasich Furniture Production Limited oga, Mr. Sunday Eze

Na jolly jolly day for the Pink Oak Cancer Trust as them sign donor partner agree with Pasich Furniture Production Limited for inside Abuja. The company oga, Mr. Sunday Eze kom announce say dem go give the cancer foundation 500k make dem use dey helep people wey dey treat cancer for obodo Naija. According by the agreement, dem go give Pink Oak 2% of their profit every 3 months.

The Oga for Pink Oak, Dr. Laz Eze talk say the donation sweet im bele well well. He talk say plenty cancer patients for Naija dey die because dem no get money to treat themselves. He come beg all Naija companies and people say make dem use church mind like Pasich Furniture dey #donatetobeatcancer.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.