Home Things wey happen Primary Healthcare: Gombe Governor don appoint new Executive Secretary

Primary Healthcare: Gombe Governor don appoint new Executive Secretary

409
0
Photo Credit: https://www.sunnewsonline.com

Gombe State Governor, Alhaji Muhammadu Inuwa Yahaya don put new oga for the state Primary Healthcare Development Agency.

Ismaila Uba Misilli, Senior Special Assistant (SSA) to Inuwa for matta about Media and Publicity, na him tell journalists say governor don put Dr. Abdulrahman Shuaibu as Executive Secretary (ES) after him sack the before ES.

“the new ES, Dr. Shuaibu be consultant, family physician before-before for Aminu Kano Teaching Hospital, Kano”. And this time wey Gombe state get SAM problem naim governor come make am ES, work go choke for our new oga be that.

TalkHealth9ja go like tell governor of Gombe say him do well, and tell our new ES congratulations, God go help am for the work wey dey him front.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.